20140304

Moses for Liverpool dey worry Keshi

Naija strika, Victor Moses no dey see ball tap wella dis season for Yankee, and de yawa don dey make jedi jedi dey worry Supa Eagus coachi, Stephen Keshi.
Na only 5 games na hin Victor Moses don tap dis year for Liverpool wey be hin club for England.
Oga Keshi kon tok say hin belle dey pepper am as Victor Moses no dey see ball play well well for hin club, becos de guy dem for hin plan for dis year world cup for Brazil.

Oga Keshi also tok say na muss make hin follow Victor Moses tok on de matta wey dey ground wen hin enta America for de play play game wey Naija get with Mexico dis Wednesday.
“I no get any wahala with John Obi Mikel, becos de guy dey tap ball well well for hin club and I dey kampe with hin own matta.
“Na Victor Moses matta na hin dey pain me for body becos de guy no dey tap ball at all and nothing wey I fit do for am.
“I know say Liverpool manija wan dey win all hin games, but I go follow Moses tok de matta wen hin enta Atlanta,” naso Oga Keshi yarn Brila FM.
Victor Moses don play 15 games dis season for Liverpool, and na only 1 gol na hin de guy manage score for de 2-2 draw wey Liverpool follow Swansea play lass year September.

No comments:

Post a Comment